-
The Lord na my shepherd, I dey kampe
-
E make me sidon for where better dey flow yanfu yanfu. And come put me next to stream make my body
thermocool. -
E panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness because of Hin name.
-
Walaii! If I waka pass where arm robber, 419 and juju
people boku, come even join boko haram reach
valley of the shadow of death sef, liver no go fail me. Your rod and staff nko? Na so dem dey like backbone dey
comfort me. -
You don arrange good fufu and Amala on top
table make I chop. See bad belle people dey look waa waa. You rub me for head with vaseline Intensive lotion. My cup come be like River Niger dey troway dey go. -
True true, better life and mercy go dey follow me till I
quench. And I go tanda for God house… lai lai I no go comot for wia better dey. God Almighty, Na you biko!
UNCATEGORIZED
Psalm 23 in Pidgin English
More in UNCATEGORIZED
-
[EVENT] Monique Live in Concert with Mike Abdul, Joe Praiz, Onos & Others
Get ready for an electrifying experience as Monique Live in Concert hosts Heaven with...
-
[AUDIO] “Beyond Religion” – Enyo Sam
Contemporary Christian and R&B/Soul artist Enyo Sam returns with his latest single, “Beyond Religion,”...
-
[VIDEO & AUDIO] “No One Like You” – Collins Ambrose
Lagos, Nigeria – Rising gospel music minister Collins Ambrose is set to make a...
-
[EVENT] Joshua Israel Presents “The Worship Is Now (TWIN)”: Gospel Concert & Live Recording
Get ready for an unforgettable spiritual encounter as Joshua Israel presents “The Worship is...